12
Job Ansa Zofar 
 1 Den Job ansa: 
 2 “True-true, una know pass evribody. 
So wen una die, wisdom go follow una die too. 
 3 But I get sense as yu get too. 
E nor get how yu take betta pass mi, 
bikos evribody know evritin wey yu dey tok. 
 4 Even my friends dey laf mi naw; 
dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. 
I bilive sey God go ansa my prayers. 
 5 Yu nor get trobol, 
but yu still dey laf mi; 
pesin wey won fall before, 
yu don kuku nak am make e for kwik-kwik fall. 
 6 But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace, 
even doh na God hand dem dey. 
God Wisdom 
 7 “Even bird and animals get many tins 
wey dem go tish yu. 
 8 Make yu ask di eart 
and sea make dem kom tish yu wisdom. 
 9 All of dem know sey na God by ensef dey 
kause all dis wahala for mi, 
 10 bikos na God hand dey hold di eart 
and evribody dey alive bikos of en pawa. 
 11 But as yor tongue dey taste food, 
na so too yor ear dey hear word. 
 12 Old pipol get wisdom? 
Abi long life nor dey bring undastandin? 
 13 But God get wisdom and pawa. 
E know and undastand many tins. 
 14 Wen God skata, 
who go fit build am again? 
And who go fit free pesin 
wey God put for prison? 
 15 Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall 
and river go only flow wen God gi-am wota. 
 16 Na God get strent and wisdom; 
di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, 
all of dem dey God hand. 
 17 E dey make leaders bihave like fools 
kon take wisdom from rulers hand. 
 18 E dey remove kings from dia throne 
kon make dem prisonas. 
 19 E dey honbol priests 
and ova-trow doz wey dey pawa. 
 20 E take di wisdom wey old pipol get 
kon silent doz wey dey advise odas. 
 21 E disgrace princess 
kon take pawa komot from rulers hand. 
 22 E open all di sekret tins wey dem hide for darkness 
kon put lite for where deep pass. 
 23 Na-im dey give nashons pawa 
kon still skata dem again. 
 24 E make leaders bi like fools 
kon make dem waka lost for desert. 
 25 Dem dey waka find road for darkness. 
E make dem stagga like man wey don drink well-well.