23
Job Ansa Again 
 1 Job kon ansa: 
 2 “Today, my komplain still dey make my heart betta; 
I nor fit hold my bitterness. 
 3 If to sey I know where I go for si God 
and how to go where E dey, 
 4 I for komplain gi-am 
kon tell am all di trobol wey I dey face. 
 5 I won know wetin E go tok 
and how E go ansa mi. 
 6 God go fight mi with all en pawa? 
No! I nor tink so. 
E go listin and ansa mi wen I tok. 
 7 Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok, 
den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever. 
 8 I don find am go east, but I nor si am. 
I nor si am for west wen I find am go der too. 
 9 Wen God dey work for nort and sout, 
I nor still si am. 
 10 Yet, God know evry step wey I dey take. 
If E sey make E test mi, 
I go klean kom out like gold. 
 11 Bikos I just dey waka follow God for back; 
for di road wey E choose by ensef 
and I nor dey waka on my own. 
 12 I dey always do wetin E tok; 
dey follow en words; nor bi my own. 
 13 E neva shange and nobody fit oppoz 
or stop am from wetin E won do. 
 14 E go do wetin E don plan for mi. 
Na-im dey kontrol my destini. 
 15 Na dis make mi dey fear and wen ever I si am, 
my hold body go dey shake. 
 16 True-true, na God make mi dey fear. 
E don distroy di mind wey I get. 
 17 Na God, nor bi di darkness make mi kwayet, 
even doh di darkness don kover my face.