29
Job Still Dey Tok 
 1 Job still sey: 
 2 “If to sey my life go fit bi as e bi before 
wen God dey look and guide mi! 
 3 Dat time, God always dey with mi 
and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness. 
 4 Dat na di time wey evritin still dey well with mi. 
Den God goodness still dey protet my house. 
 5 Den God still dey with mi 
and all my shidren gada round mi. 
 6 My melu and goats dey give mi plenty milk 
and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong. 
 7 Wen ever di town eldas dey meet 
and I go der, 
 8 yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom 
and old pipol dey stand greet mi with respet. 
 9 Di leaders wey dey lead di pipol 
go stop to tok. 
 10 Even di pesin wey dey important pass, 
go shut up for mi. 
Job Dey Good Well-well 
 11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi. 
Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi. 
 12 Wen poor pipol kry kom meet mi, 
I dey help dem; 
I dey help pikin wey nor get papa 
and mama and doz wey nor get where to go. 
 13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi 
and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die. 
 14 I dey always do betta tin. 
Evritin wey I do dey always dey good. 
 15 Na mi bi blind pipol eye 
and doz wey nor fit waka, 
na mi bi dia leg. 
 16 I bi like papa to poor pipol 
and I dey setol matter even for doz wey I nor know. 
 17 I dey distroy wiked pipol pawa 
kon release di pesin wey dem katch. 
Job Get Mind 
 18 “Den I sey, I go get long life 
kon die for my house without trobol. 
 19 I go bi like tree wey en rut get wota; 
wey dew dey wet en branches. 
 20 Evribody go dey praiz mi 
and my pawa nor go fail. 
Job Good Karata 
 21 “Wen I dey advise pipol, 
dem dey kwayet listin to wetin I dey tok 
 22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish. 
My word dey enter dia mind well. 
 23 Evribody dey welkom mi, 
just as farmer dey welkom rain wey won fall. 
 24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again 
and my betta face dey give dem hope. 
 25 I dey lead dem as king dey lead many pipol 
kon konfort dem wen dem dey face trobol.