30
Job Wahala 
 1 “But pipol wey yong pass mi 
dey laf mi naw! 
Pipol wey dia papa nor dey yuzful, 
wey I nor go even allow join di dogs wey dey guide my sheep. 
 2 Dem bi yuzles pipol 
and dem too weak to do any work for mi. 
 3 Bikos dem poor well-well and honga won kill dem, 
dem kon dey chop dry rut and dirty for nite. 
 4 Dem dey pul and chop plant for desert; 
even di small tree wey en rut nor get taste, 
dem dey chop am too! 
 5 Evribody dey shaut follow dem like tif 
kon porshu dem komot from di land. 
 6 Dem dey stay for inside hold wey en wota don dry 
and inside rock too. 
 7 Dem dey bihave and shaut like animals 
and gada togeda for bush. 
 8 Dem nor get sense or name 
and dem porshu dem komot di town. 
Job Dey Shame 
 9 “Naw, dem dey kom laf 
and take mi sing. 
Na mi dem dey take do joke naw. 
 10 Dem dey trit mi like sey I dey smell; 
dem feel sey dem too good pass mi, 
so dem kon spit for my face. 
 11 Bikos God don make mi weak and I nor get who go help mi; 
dem kon use all dia vexnashon take face mi. 
 12 Dem gada kon fight mi; 
dem drive mi from one place to anoda 
and dem don agri for wetin dem go do mi. 
 13 Dem follow mi as I dey run 
kon dey try to distroy mi 
and e nor get who fit stop dem. 
 14 Dem kon attack mi from difren angle. 
Dem jump press mi wen I don already fall. 
 15 Fear don chop my full body; 
my respet don go like wota proof wey breeze blow 
and my glory don vanish like kloud. 
No Hope For Job 
 16 “I won die naw; 
bikos na so-so pains full my days. 
 17 Di nite dey make my bones pain mi; di pains dey bite mi 
and e nor gri stop. 
 18 God hold mi for neck with pawa 
kon make di klot wey I wear, dirty. 
 19 E trow mi for mud and naw, 
I bi like dust and ashes. 
 20 God, I dey koll Yu, 
but Yu nor gri ansa and wen I pray, 
Yu nor gri listin to my prayers. 
 21 Yu dey do mi anyhow; 
Yu dey ponish mi with all yor pawa. 
 22 Yu allow breeze blow mi go; 
Yu trow mi up-and-down for inside strong breeze. 
 23 I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; 
di place wey Yu keep for evribody. 
Di Pass 
 24 “True-true, nobody go fight poor pesin, 
wen e kry sey make dem help am from en trobol. 
 25 Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry 
kon sorry for pipol wey nor get at-all? 
 26 Na happiness and lite I dey hope for, 
but na trobol and darkness I kom get. 
 27 Pain and worry don skata my body; 
I dey sofa evriday. 
 28 I just dey waka for darkness and I nor dey si lite at-all. 
I dey beg for help for where crowd Gad put. 
 29 I don kry sotey my vois don krack 
and my neck don long like Ostrich own. 
 30 My skin don black finish 
and strong fever dey katch mi naw. 
 31 I nor fit remember di last time wen I hear betta music, 
bikos na only song wey go make mi mourn and kry, 
naim dem dey play.