God Tok Against Israel
1Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey:
“For dis land, nobody love mi,
dey faithful or si mi as en God.
2Dem nor dey keep di promise wey dem make.
Instead, dem dey lie, kill, tif
and sleep with oda pipol husband and wife.
Na so-so wiked tins dem dey do
and dem dey kill each oda evriday.
3So di land go mourn,
bikos evritin wey dey inside, go die.
All di animals, birds and even fish,
go die too.”
God Akuse Di Priest
4God sey,
“Make nobody akuiz or blame di pipol,
bikos na una wey bi priests,
I dey tok against.
5Una go fall for day time
and una wayo profets go fall with una for nite,
den I go distroy una mama Israel.
6My pipol don die finish
bikos dem nor know mi.
Since di priests don rijet mi,
misef go rijet dem as my priests.
Since una don forget una Oga God laws,
misef go forget to bless una shidren.
7As di priests dey plenty,
na so dia sin against mi, dey plenty too.
So I go turn dia honor to disgrace.
8Bikos dem dey make money from my pipol sin,
dem kon dey kommit more sin.
9Dem go sofa di same ponishment with di pipol!
I go ponish and make dem pay
for di evil and wiked tin wey dem do.
10Even wen dem chop food,
dem nor go beleful;
dem go dey sleep with each oda,
but dem nor go born pikin,
bikos dem don turn from di Oga God
kon dey follow oda gods.”
God Tok
11God sey,
“Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem
nor get sense again.
12Dem dey ask wood make e show dem
wetin go happen for future!
Na stik dey tell dem
wetin dem won know!
Dem don leave mi.
Dem bi like ashawo and dem don give diasef
to oda gods.
13Dem dey offa sakrifice on-top mountin
kon burn incense for di hills and under evry tall tree,
bikos dem dey enjoy di shade!
Bikos of dis, una dotas dey do ashawo
and una dota in-law dey sleep with oda pipol husband.
14I nor go ponish una dotas wen dem dey do ashawo
or una dota in-law wen dem dey sleep with anoda pesin husband,
bikos di men for di temple dey make sakrifice
and sleep with ashawo too.
So, pipol wey nor get sense,
na distroshon go end dia life.
15But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi,
make una, Judah pipol nor bihave like dem.
Make una nor go woship for Gilgal or Bethel
or use God name take make promise for der.
16Just as melu sturbon, na so Israel pipol bi.
So, how I go fit take feed dem
like lamb wey dey for open field?
17Bikos of di juju wey Efraim pipol dey serve,
curse dey dia head.
So make una nor go near dem!
18Afta dem don drink plenty wine,
dem go-go sleep with ashawo;
bikos dem like disgrace pass honor.
19So, breeze go karry dem go
and dem go shame
sey dem dey offa sakrifice give juju.”