God Mesi
1God sey, “All of una wey wota dey hongry,
make una kom drink from dis wota!
Una wey nor get money,
make una kom chop!
Make una kom drink wine and milk
and una nor go pay anytin!
2Why una dey spend una money for wetin
nor go beleful una?
Why una dey spend una money
wen una know sey hongry go still kill una?
Make una listin and do wetin I tok,
den una go enjoy di best food.
3My pipol, make una open una ear
as una dey kom meet mi;
make una kom meet mi and una go get life!
I go give una kovenant wey go last forever
kon give una di blessings wey I promise David.
4I make am leader and kommander for many nashons
and I show dem my pawa thru am.
5Naw, una go gada oda nashons wey una
nor know before.
And nashons wey nor know una before,
go run kom meet una!
Bikos mi wey bi di Oga una God,
di Pesin wey bi Israel God wey dey holy,
go make all dis tins happen.
I go give una honor and glory.”
6Make una turn and pray to God
naw wen E dey near una.
7Make wiked pipol turn from dia wiked life
kon shange di way dem dey tink.
Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God,
bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
8God sey, “I nor dey tink as una dey tink
and una ways difren from my own.
9As heaven high pass di eart,
na so my ways and di way I dey tink,
high pass una own.
10My words bi like snow and rain
wey dey kom wota di eart from di sky.
Dem dey make plant grow and provide seed
wey dem go chop and plant.
11Na so e bi too with di word wey I dey tok;
e go must do wetin I plan for am.
E go must do evritin wey I send am make e kom do.
12Una go komot from Babilon with joy
and dem go lead una komot from di town with peace.
Di mountins and hills go dey sing
and di trees go dey shaut with happiness.
13Cypress trees go grow for where grass dey naw.
Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey.
Dis sign go dey forever and e go dey remind una
about wetin mi wey bi God don do.”