Praiz Song
Sabat Day Song
1E dey good to tank God.
Yes! Awa belle dey sweet us
wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.
2For morning, e dey good
to tok about yor love
wey nor dey fail
and for evening,
wi go sing of yor faithfulnes,
3with harp wey get ten rope and jita.
4My God, Yu dey make mi happy
bikos of evritin wey Yu do
and I go sing praiz Yu,
bikos Yu dey good to mi.
5Wi dey si di great work wey Yu do!
Di tins wey Yu dey tink, deep well-well.
6Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do
and na only fools nor go undastand sey:
7“Wiked pipol dey grow like grass and doz wey dey do evil dey prosper,
but God go distroy dem forever.”
8But Yu, my Oga God,
dem go praiz Yu forever.
9Yor enemies go die trowey and all di pipol wey dey do evil,
go skata.
10But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass,
take anoint mi.
11My eyes don si my enemies dey fall
and my ear don hear as God win doz wiked pipol.
12But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree
and dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon.
13Bikos God don plant dem for en house,
dem go grow well.
14Dem go still dey produce fruit for old age!
Dem go dey strong and fresh well-well.
15Dem go sey, “God dey judge well!
Na-im bi awa Rock and E nor dey do bad tin!”